Skip to content
Words Rhymes & Rhythm

Words Rhymes & Rhythm

Words Rhymes & Rhythm Publishers

Header Advertise
Menu
  • HOME
    • ABOUT US
    • OUR CSR
    • CONTACT US
  • cọ́nscìò
  • FEATURES
    • BOOK REVIEWS
    • ESSAYS
    • INTERVIEWS
    • WRITING TIPS
  • POETRY
  • FICTION
  • SUBMISSIONS
  • NEWS
    • CALL FOR SUBMISSIONS
  • PUBLISHING
    • PUBLISHING PACKAGES
    • 7 REASONS WHY
  • DOWNLOAD
  • Home
  • POETRY
  • OUR KONTRI FINE
POETRY

OUR KONTRI FINE

Staff WriterApril 2, 2013July 16, 2017

Share

Facebook
Twitter
LinkedIn
Read Time:1 Minute, 19 Second

Our Kontri Fine
www.facebook.com/WRRPoetry [Our Kontri Fine]
Our kontri fine
I say we kontri fine well well,
Bomb na we flower,
Na human blood we dey take wet am
We tears no get subsidy:
E dey flow like River Niger

I say our kontri fine no be small!

Our presido na good man
I say our presido na korekt man
E dey wack big fat turkey for breakfast
Wash am down with imported wine
But e say na the bone good for us
The calcium go give us better strong teeth

I say we presido na korekt man!

Ministers na gbaski people
I say ministers be tripple tuale
Dem dey do holiday for Dubai,
We do our own for Dustbin,
Dem ride fat fat cars,
We dey hang for molue,
Dem boko us for morning
And haram us for evening
Still, we dey give dem rankadede

Dis ministers na gbaski people, ye!

The gofnors na we personal persons,
I say the gofnors na we padi padi,
Dem chop and clean mouth for dem mansions
Follow us do our hunger strike sef.
“We feel the pains of the masses,” dem
Talk for dem fine fine grammar
Dem come laff us for our back

I say dis gofnors na good padi padi!

Baboon dey work
Monkey dey chop and relax
I say na monkey dey enjoy the sweet of baboon sweat
We dey wash hand with saliva when we house
Dey riverside…

But one day, the river go overflow…!

Written by: Tonye Ville
Edited by: Kukogho Iruesiri Samson

About Post Author

Staff Writer

info@wrr.ng
https://wrr.ng/about-us/

Share this:

  • Twitter
  • Facebook
  • LinkedIn
  • WhatsApp
  • More
  • Telegram
  • Tumblr
  • Print

Related

Tagged Corruption, elections, electorates, leaders, looting, monkey, Nigeria, Pidgin, poem, politicians, Politics, Poverty, vote

Post navigation

Previous

Previous post:

WOMAN, MAN… (a poem in parts)

Next

Next post:

HELL FIRE DON COME WE KONTRI?

Previous post WOMAN, MAN… (a poem in parts)
Next post HELL FIRE DON COME WE KONTRI?

One thought on “OUR KONTRI FINE”

  1. nedrian says:
    April 2, 2013 at 11:31 am

    Reblogged this on nedrian and commented:
    The sad tale of a beautiful country

    Reply

Say something about this post Cancel reply

Icon

CỌ́N-SCÌÒ MAGAZINE: ‘PACESETTERS’ [ISSUE 2, VOL. 2 | OCTOBER 2022]

1 file(s) 10.11 MB
Download
Close
Menu
  • HOME
    • ABOUT US
    • OUR CSR
    • CONTACT US
  • cọ́nscìò
  • FEATURES
    • BOOK REVIEWS
    • ESSAYS
    • INTERVIEWS
    • WRITING TIPS
  • POETRY
  • FICTION
  • SUBMISSIONS
  • NEWS
    • CALL FOR SUBMISSIONS
  • PUBLISHING
    • PUBLISHING PACKAGES
    • 7 REASONS WHY
  • DOWNLOAD
Social profiles
  • HOME
    • ABOUT US
    • OUR CSR
    • CONTACT US
  • cọ́nscìò
  • FEATURES
    • BOOK REVIEWS
    • ESSAYS
    • INTERVIEWS
    • WRITING TIPS
  • POETRY
  • FICTION
  • SUBMISSIONS
  • NEWS
    • CALL FOR SUBMISSIONS
  • PUBLISHING
    • PUBLISHING PACKAGES
    • 7 REASONS WHY
  • DOWNLOAD

ABOUT US

Words Rhymes & Rhythm Ltd. (RC 1234112), is a foremost publishing and educational institution that supports and promotes Nigerian writers and writings talents through several initiatives like contests, prizes, and an annual literary festival. Our publishing susbsidiary is AUTHORPEDIA.

CONTRIBUTE

QUICK LINKS

  • CỌ́NSCÌÒ
  • CONTACT US
  • DOWNLOADS
  • PUBLISHING
  • SUBMIT TO WRR
  • SERVICES
  • HOME
    • ABOUT US
    • OUR CSR
    • CONTACT US
  • cọ́nscìò
  • FEATURES
    • BOOK REVIEWS
    • ESSAYS
    • INTERVIEWS
    • WRITING TIPS
  • POETRY
  • FICTION
  • SUBMISSIONS
  • NEWS
    • CALL FOR SUBMISSIONS
  • PUBLISHING
    • PUBLISHING PACKAGES
    • 7 REASONS WHY
  • DOWNLOAD
Copyright Words Rhymes Rhythm Ltd. All Rights Reserved.
 

Loading Comments...