Site icon Words Rhymes & Rhythm

HOW?

Read Time:1 Minute, 9 Second

www.facebook.com/WRRPoetry [How?]
How wi chudren wan take fie God,
wen papa and mama no sabi God?
How gel pikin wan tek bi beta waif?
wen ha mama dwelin ples na mama ekaite domot?
How boy pikin wan sabi to bi beta papa
when him papa frends na grin and bran botuls?

Wai dem col am eksam,
wen skul children don get d kuweshion
and evun ansa bifo eksam?
How naija go better,
when dem cari awa money for bilions
dash pesin say na wedding gift?

How am robiry no go kontiniu,
wen all we dae hear na
“chop my moni”
“all I want is ur waist”
How prostitushon no go kontiniu
when everybody wan opdet status fo blackberry?

How di sekurity levul
fo wi kontri wan beta
Wen polis dea supply am robas?
How wi wan take
bi most developed kontri
wen aba no go stop to do fek tins?

How you wan take go hevun,
if you no wan liv et?
Abi yu don hie say person de Abuja
and lagos fo di same time?
How wi wan tek promot poyetri,
if you no laik, koment and shia dis piece?

Written by: Williams Enechojo UniqueGloria
Edited by: Kukogho Iruesiri Samson

Exit mobile version