Site icon Words Rhymes & Rhythm

GOD PIKIN

Read Time:1 Minute, 3 Second

www.facebook.com/WRRPoetry [God Pikin]
As I waka through the shadow of death
With Baba God, I go survive
Dem bad bele don eye me from birth
Upon their wahala, I still dey alive

Satan tell me sey im fo sidon my matter
Sey im go see wetin I fit to do
But I giv wetin I get to God pata pata
Na so Satan pick race, foget im shoe

Dem think sey na only one papa I get
Na now dem know sey I get Oga at the top
Oga wey no dey put me for regret
Come dash me blessing wey no dey stop

Na so so praise I go give am
As I dey waka everyday
I no need cry go Pastor or Imam
The person wey I need, na my heart in dey

Dem bambooz my head with palava
Wey I no fit to even carry
Dem come join spoil my cassava
But still I no see sand for my garri

I stand gidigbam like nothing dey shele
All dem fit do na waka pass
Dem for don comot my matter jeje
If dem know sey God pikin no dey carry last

Written by: Ogoluwa Simon Ojewale

Exit mobile version