Site icon Words Rhymes & Rhythm

WAKA FO HAND

Read Time:38 Second

www.facebook.com/WRRPoetry [Waka Fo Hand]
Mai gud frend,
Eniwia pesin stat, na stat.
Wetin pesin put fo front, na im pas
Pesin ai stand gidigba, don pas.

Waka get op and daun
On top of waka, som stop
On top ol waka, som de waka
Na waka ol of os de du fo laif waka.

If yu stat waka, waka go enta waka
Komot ai fo yo waka, waka go waka
Hau yu go waka rich beta
Wen yu no waka rich yo waka?

Wi ol get waka fo hand
Waka de land, de komot
Waka ful awa hand and awa land.
Waka no de finish fo hand.

*Puem written in Naija languej

Written by: Eriata Oribhabor

Exit mobile version