Site icon Words Rhymes & Rhythm

I NO FIT SHOUT

Read Time:39 Second

www.facebook.com/WRRPoetry [I No Fit Shout]
“Na wen u break cook egg
U go sabi say
some dey carry double yoke”
Na im be the best answer
I get from oga minister
When i ask why draw-draw
No fit comot for our ogbono soup

Na im i say no need to ask
Why e be say the more
Naija dey hammer pepper
Country-man dey suffer well well
Plus the more dem dey fart
The remnants of Aso sengemenges
The more we no fit fat
Pass the size of hotel soap

Before I go hear say
Na Arabs kill Jesus
And the baddest kobo-legs
Are made in China

Written by: Ayiba Tare Ojukonsin
Edited by: Kukogho Iruesiri Samson

Exit mobile version