Site icon Words Rhymes & Rhythm

BABA NA YOUR GRACE

Read Time:1 Minute, 28 Second

www.facebook.com/WRRPoetry [Baba Na Your Grace]
Ya kin love no be koni koni love, e no dey anoda place
Ya love for we life dey make us kolomental, we dance alanta
Nah sake of say you dey gidigba we dey jukpa, dance azonto

Na efriday we dey see danger but you dey alert us
We pakurumo dey go inside ya light where wahala no dey
Ya love dey hala kokoroko when devil try kalangu with us

9ja jaga jaga, poor man dey shout oleku,
As the rich dey sing oti yan yan. If no be ya love
Na how we masses wan take survive for dis wicked world?

Aproko people full ground, dem no gbadun our waka
Na under ya odeshi umbrella we hide for korekt protection
Make the bullets of the gbomo gbomo people no for see us

We sabi the kin life we dey live, no be say we holy pass
Still yet dey make us fly over the moon with ogologondu
Baba God noni, nah you we dey luk as this lyf foka sibe

Use your kondo nack ol the Judas wey dey spoil we kontry
Nack them, ol of them with heavenly apako
Ol of dem wey dey promise heaven give us hell

As we go just dey kukere dey groove for this world
With joy of anointed iworiwo for our dry lips
And our blood dey boil with putu putu no ofe

We know say e go better and we go hala you with praises
Because na you fight our battles. We go talk am as we see am
Even if spiritual konji hold us, we go still shout halleluiah!

Written by: Moses Opara
Edited by: Kukogho Iruesiri Samson

Exit mobile version